This na one buka wey I dey like to go The food sweet sote e go make your mind blow Day and night Iya Bas how she do am I no know They think say na jazz, my broad no be so People people make una come o Iya Basira e don jazz me o, ooo Everybody helep save me o I no dey sabi chop ati my mother or my girlfriends place People people make una come o Iya Basira e don jazz me o, ooo Everybody helep save me o I no dey sabi chop ati my mother or my girlfriends place Long throat na food go kill you (No be so) I say na food go kill you (Oga mi no be so) Weytin dey be say e get one day wey I say I go play go see my paddy Sunday Na so I reach there but Sunday e don high on beer Luckily for me him junior broad eye e clear He say make we stroll to the areaittle did I know that I was strolling to my burial Right there were oshodi bus dey load Was a little buka close to the mainroad I laugh when e pass the door E tell me say hin name na Iya bas for short But I bow when e order Iwesiatewa, ero mm purewater not even mineral I come gree say I go manage to chop am Before I realize I dey order second round Third round, Forth round I never still stop Weyting Iya Basira e give me chop ehn? People people make una come o Iya Basira e don jazz me o, ooo Everybody helep save me o I no dey sabi chop ati my mother or my girlfriends place People people make una come o Iya Basira e don jazz me o, ooo Everybody helep save me o I no dey sabi chop ati my mother or my girlfriends place Long throat, na food go kill you (No be so) I know, I say na food go kill you (Oga mi) You think say na play when I say na the way wey I dey (weytin do am) e no day ok Weyting be your own advice, I don dey steal my paddy money to buy Iya Basira rice Even on my girlfriend birthday When she dey wait make I take am to Ocean View I no know when I pass the place The only thing wey dey my mind na Iya basira palm oil stew Ah! Kilon kilon shele shele Me I never see this kind juju, telle telle All those wey go vex kpele kpele, but I hear say Iya Basira na I sure say still I go go there go sidon Order my first round move to second round, third round forth round I no dey ever stop Weyting Iya Basira come give me chop? Mo gbeee People people make una come o Iya Basira e don jazz me o, ooo Everybody helep save me o I no dey sabi chop ati my mother or my girlfriends place People people make una come o Iya Basira e don jazz me o, ooo Everybody helep save me o I no dey sabi chop ati my mother or my girlfriends place Officer abeggi follow me to the place Everybody don telli me I dey craze My girlfriend don leave me My mother no gree see me My paddy mm! Iya basira e don kill me Officer abeggi follow me to the place Everybody don telli me I dey craze My girlfriend don leave me My mother no gree see me My paddy eey! Iya basira e don kill me Oya people, people make una stop officer e don come Where the woman? Hin dey inside, (oga I dey come) Woman na weyting u dey give people chop Wey dey cause all this wahala, casala oya make we talk Oga sir true to God, Nothing wey I dey put for the food wey I dey cook Na God dey make am good.l Na which kind talk be that Say na God dey cook the food Abi u think say I be fool no be juju u dey put Infact I dey suspect say na ... you wash put Sote people dey queue come dey rush for your stew Well to confirm am bring am make I chop small Give me fufu 90 naira plus that soup wey dey draw Chaii correct this food sweet no be small Shey una no go vex if I still order for more Officer no worry na the food be this Oya people, people make una go, Case dismiss People people make una come o Iya Basira e don jazz me o, ooo Everybody helep save me o I no dey sabi chop ati my mother or my girlfriends place People people make una come o Iya Basira e don jazz me o, ooo Everybody helep save me o I no dey sabi chop ati my mother or my girlfriends place People people make una come o Iya Basira e don jazz me o, ooo Everybody helep save me o I no dey sabi chop ati my mother or my girlfriends place People people make una come o Iya Basira e don jazz me o, ooo Everybody helep save me o I no dey sabi chop ati my mother or my girlfriends place