Kishore Kumar Hits

Snazzygrin - Olofofo şarkı sözleri

Sanatçı: Snazzygrin

albüm: Oct10 RAP Dialogue


Glory to God
Honor to Mary
Erhi
Oko e don hook u
Zaah
Anywhere me I dey my guys dey there
If u know where my mind dey my guy your mind go dey there
U know where I dey come from
No go there
If I tell u how the matter be u no go like go there
Olofofo Na my matter dem dey yarn oh
Dem wan see me fail but i dey ball like Ighalo
Dem carry my mata for head e be like afro
Dem dey yarn apata dem dey talk for my back oh
Snazzy still dey trek he never buy car
Some say he no dey trek na steady he dey use cab
He no dey carry body na why I like am
Some say he too dey carry body na why I no like am
I be like tortoise I always dey their discussion
U know say the story no go make sense if I no dey there
Na me dem dey talk about anytime oh
Na me dem dey talk na my story wey dey pain dem
Life no easy but wey dey package am
Street be like breast wey don fall we still dey package am
If your girl no fine at all my guy package am
If better money come na only you go tiwa savage her
Life of a star no be bear
Focus on your hustle e no easy anywhere
I focus on my hustle my guy the vision clear
I don't have to be a prophet to see the vision clear
Why always me like balotelli
Shey be na me dem dey see now for their parlor telli
I gat all eyes on me feeling like makaveli
I be like beast for the beat your best rapper dey fear me
Chee
I no fit rob like zubby micheal
I dey use my head yes I dey use my mic oh
No go dey do ritual like kanayo o kanayo
Kanayo dey do ritual but yet he still dey owe kanayo
This Life no balance but I stand gidigba
Na time e go take even wizkid wear okirika
If to say life Na nollywood I for don make am
Na to comot village enter city
E no go take time
This no be movie na real life
Too many girls na hip hop be my real wife
Please don't try this at home e no be real life
Wetin undertaker dey do dem no dey do am for real life
E get some kind of things we no fit talk o
Olorun Oba kari aye
Some people get the food, them no fit chop o
Lord of mercy open my way
That's why you gats to low key
Omo olope you gats to low key
Shout out to all my OGs wey dy ginger me on a daily
Na only God wey dey bless person
If not for God
This hustle for dey stress person
Some people talk wan dey vex person
But I no dey leave my life to impress person
Olofofo dem try to bring me down oh
Na hustle I hustle no be fight
Olofofo dem try to bring me down oh
But if I fall I must to rise
Omo wetin dey sup
Zaah
E get some kind of things we no fit talk o
Olorun Oba kari aye
Some people get the food, them no fit chop o
Lord of mercy open my way
That's why you gats to low key
Omo olope you gats to low key
Shout out to all my OGs, wey dy ginger me on a daily
Olofofo dem try to bring me down oh
Na hustle I hustle no be fight
Olofofo dem try to bring me down oh
But if I fall I must to rise

Поcмотреть все песни артиста

Sanatçının diğer albümleri

Benzer Sanatçılar